The No. 1 website for Nigerian Entertainment

Nkiru...

One guy bin like one babe called Nkiru (but Nkiru no too fine) and im come get one parrot wey dey talk well well for house. Nkiru don dey shun di guy but finally she come gree and dem comot.

After Nkiru don chop finish dem come land di guy house. As she enter house na im di parrot just shout "Nkiru, you ugly oh". Nkiru just ignore am.

Everyday Nkiru land na so di parrot go shout "Nkiru, you ugly oh".

Finally Nkiru go meet the guy come tell am say "Bassey, I like you but dis parrot dey make me vex and if im continue I no think say me and you go fit dey do oh.."

Ah, na im Bassey run go meet the parrot. Come warn am say if im say dat thing again im go wound am.

After two days Nkiru come land again. Next thing she hear na "Nkiru, you ugly oh". Bassey just rush di parrot come begin beat am. E beat the parrot oh. Im come say dis na the last time wey im wan hear di parrot talk about Nkiru like dat. Den im come put am back for im cage.

Next Friday Nkiru come land again. Dis time di parrot come quiet. Saturday reach di parrot just dey restless im no fit talk. For Sunday as Nkiru dey waka, di parrot just dey jump up and down but im no still talk.

As Nkiru wan comot di house for Sunday nite na im di parrot just shout
"psss...Nkiru,......... you know now!!"
<<<Back
Click here to return to main page

Check out the rest of the features on agidi.com

 

agidi.com

 

 

EXTRAS

     

About Naija

Games

Listing

 
     
     

More

 

Editor's Picks

Literature
See picture
 
Literature
See picture
 
Photo
See picture
 
Video
See picture
 
Literature
See picture
 
Literature
See picture
 
 
A selection of our favourite contents
P-Square
Preview
Junior & Pretty
Atinga
2 Face Idibia
 
Tell us what you think about agidi.com!
 
 
 

About Us | Advertise with Us | Listing | Contact Us | Terms of Use | Site Map

©2008 agidi.com. All rights reserved.