The No. 1 website for Nigerian Entertainment

Contri Pipo (Country People)

by Arukaino Umukoro

Money dey yab man. Sometime
E dey bi like pepper for yansh
Gari don cost
She na sansa
Na im poor man go chop?

Naija pikin wey sabi oyinbo
Go talk say
“Di masses are shuffering”,
but di tori for di matter be say
no be we all dey go for ‘mass'
for insai church
abi, na efiribodi be catholic?

Dem say uncle Sege don get church
For insai di Aso villa,
She hin don become pastor?
Abeg, make our SINators
An' house of representakeTIFs
Helep mi ask am
Make hin do beta prayer
For dis we contri too o!

Cos, e bi lai say our sins
For dis obodo naija
Don too plenty
Maybe dat is why we de suffer…
Gofment suppose import agric bees
Come dis contri
So dat e go dey flow
Wit' milk and honey.
We kuku ma get cow boku
For we north sef,
Abi dem don start to import am too?

Na only shit I no say
Wi pipo no dey import…
‘Our contri is full of shit, man!'
Which way, Nigeria?
I remember say Sonny sing dat wan
But, she hin no know say
All of we road do spoil finish?
Make we kuku use ahroplane, abi?

But, na efiri day our gofment pipo
Dey mess (for) up!
Na how we go come do am now?
Abeg, me ah don tire for dis Naija sef!

<<<Back
Click here to return to main page
 

Check out the rest of the features on agidi.com

 

agidi.com

 

 

EXTRAS

     

About Naija

Games

Listing

 
     
     

More

 

Editor's Picks

Literature
See picture
 
Literature
See picture
 
Photo
See picture
 
Video
See picture
 
Literature
See picture
 
Literature
See picture
 
 
A selection of our favourite contents
P-Square
Preview
Junior & Pretty
Atinga
2 Face Idibia
 
Tell us what you think about agidi.com!
 
 
 

About Us | Advertise with Us | Listing | Contact Us | Terms of Use | Site Map

©2008 agidi.com. All rights reserved.