The No. 1 website for Nigerian Entertainment

Cries of the Common Man

by Cade

I no understand this kin life again

Eferyday na so so wahala

Eferytime we dey pray for change

But na still the same palaver.

 

To chop now na from hand to mouth

Efery new day na another headache

Young men don today turn touts

O boy, I no understand this kin fate.

 

Wetin these our leaders dey do sef?

Wey be say man go dey here dey suffer everyday

Abi dem all don become deaf

Or abi dem jus no wan help us in anyway.

 

One-day monkey go go market, e no go return,

The youths for this country don dey dey impatient

One day na so this country go jus burn

Becos those wayo people for government no wan repent.

 

Make una no say I no talk am O

A man no fit spend him whole life for suffer

One day go be one day, all-man go hear am

The devil inside common man go show wetin e get to offer.

<<<Back
Click here to return to main page
 

Check out the rest of the features on agidi.com

 

agidi.com

 

 

EXTRAS

     

About Naija

Games

Listing

 
     
     

More

 

Editor's Picks

Literature
See picture
 
Literature
See picture
 
Photo
See picture
 
Video
See picture
 
Literature
See picture
 
Literature
See picture
 
 
A selection of our favourite contents
P-Square
Preview
Junior & Pretty
Atinga
2 Face Idibia
 
Tell us what you think about agidi.com!
 
 
 

About Us | Advertise with Us | Listing | Contact Us | Terms of Use | Site Map

©2008 agidi.com. All rights reserved.