The No. 1 website for Nigerian Entertainment

Kish Me Quick

by Cade

Baby, first time I sight you, I know say you too fine

For inside me, I come begin to fell one kin

I ask myself, which kin girl be this wey I see

I come dey imagine, what if she Kish me.

 

Your pretty face dey begin my day

Your smile alone better pass any pay

True, true, love wan finish me

Abegi O fine girl, come kish me.

 

You are the only sugar in my tea

The only mosquito that can ever bite me

The only ripe orange my eyes fit see

Come touch me baby, come kish me.

 

Even if I vex for efery other person in this world

I no fit vex for this fine girl.

My love for you deep pass any kin sea

Come kish me please fine sisi.

 

I dream about you from morning till night

I dream about you even under sunlight.

Because of you I no fit chop for one week

So Chibaby better come Kish me quick.

<<<Back
Click here to return to main page
 

Check out the rest of the features on agidi.com

 

agidi.com

 

 

EXTRAS

     

About Naija

Games

Listing

 
     
     

More

 

Editor's Picks

Literature
See picture
 
Literature
See picture
 
Photo
See picture
 
Video
See picture
 
Literature
See picture
 
Literature
See picture
 
 
A selection of our favourite contents
P-Square
Preview
Junior & Pretty
Atinga
2 Face Idibia
 
Tell us what you think about agidi.com!
 
 
 

About Us | Advertise with Us | Listing | Contact Us | Terms of Use | Site Map

©2008 agidi.com. All rights reserved.